Header Ads Widget

Ticker

6/recent/ticker-posts

Kolu Wizkid no send you ooo


 

One video don dey fly up and down for Instagram wey show Kolu tattoo “Wizkid” for him forehead 😭.


According to Kolu, he talk say he be die-hard fan of Wizkid, and since we sabi say Kolu sef dey try sing, he dey plan make he drop collabo with Big Wiz.


But omo comedy no dey finish for this life 😂. Kolu wey people still dey use Google Translate before dem understand him lyrics, dey reason collabo with Wizkid?


Lesson of the day: Fc 🦅 say Even if Kolu tattoo “Wizkid” for hin kidney, e no mean say Big Wiz go look hin side 😆. Ask Cater Efe, he go explain tire!


       

Post a Comment

0 Comments